Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -

Ezekiel 15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English


Di Vine Parabol

1 Den, God kon tell mi:

2 “Man pikin, na how dem won take kompare vine with tree for forest?

3 Yu fit use di vine do anytin? Yu fit even hang sometin on-top am?

4 E only dey yuzful as firewood. Even if di wood nor burn skata finish for di fire, yu still fit use am do anytin?

5 E nor bin dey yuzful even before dem burn am, so na naw wey fire don burn am, e won dey yuzful?”

6 Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Just as dem dey take vine for forest kon go burn am, na so I go take distroy

7 and ponish Jerusalem pipol. Dem don eskape one fire, but naw, betta fire go burn dem finish. Wen I don ponish dem, den una go know sey na mi bi God.

8 Dem nor dey respet mi, so I go turn dia land to desert.” God wey get pawa don tok.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Wycliffe Bible Translators, Inc.
ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:



ကြော်ငြာတွေ