Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 9:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 9:9
43 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Zadok di priest, Natan di profet, Benaya and di royal bodyguards kon put Solomon for David horse and dem escort am go Gihon wotaside.


Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una. Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.


“I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”


Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book.


Make evribody wey dey for Zion shaut and sing! Bikos Israel God dey holy and great and E dey stay with wi wey bi en pipol.”


Dis message na about di animals for Negev: For der, di pipol pak dia propaty and money on-top donkey kon travel pass one land wey wahala and trobol full; where lions, snake and oda wiked animals dey stay. Dem travel go meet pipol wey nor go fit help dem.


Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.


So Jerusalem, make yu go on-top high mountin. Make yu prish di good news! Koll Zion pipol with loud vois, den announce di good news! Shaut as yu dey tok and nor fear at-all. Make yu tell Judah towns sey God dey kom!


Yes! Na only mi bi God; di only One wey dey save una.


Bikos na Mi bi di Oga wey bi una God. Israel pipol God wey dey holy, wey save una. I go sell Egypt, Sudan and Seba pipol, so dat una go dey free.


So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.


Si as e dey good to si messenja wey dey kom give una peace and good news from di mountins! E dey announce sey una don win kon tell Zion pipol sey, “Una God na king!”


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


sey, God dey announce give di whole world naw sey: “Make una tell Jerusalem pipol sey God dey kom save dem and E dey kom with doz wey E don already save.”


Dem go serve mi wey bi di Oga dia God and na one of David shidren-shidren, go bi dia king.


Dem go distroy una with fire. Una blood go flow for una own kountry and nobody go remember una again.’ ” God wey get pawa don tok.


But I go love and sorry for Judah pipol. Mi wey bi dia Oga God, go save dem, but e nor go bi thru war, swod, bow, arrow, horse or doz wey dey ride di horse dem.”


But Jerusalem; di place where nor-tin bad go happen to God pipol, yor royal strent and pawa go kom back again. Di king go get pawa for Jerusalem again.


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


So Zion pipol, make una shaut and happy as una dey sing, bikos I dey kom meet and stay with una. Dis na wetin Oga God tok.


E go born boy and yu go koll am ‘Jesus,’ bikos e go save en pipol from dia sin.”


Make una follow mi and learn from mi, bikos I gentol, I nor dey karry body up and I go give una peace for una mind.


dey ask, “Where di Jew king wey dem just born? Wi si di star wey tok about am, so wi kom woship am.”


Dem bring di small donkey kom meet Jesus kon spread dia klot on-top am, den Jesus kon sidan put.


Den e kon use wetin Moses and all di profets rite take tell dem wetin God tok about am for en word.


Netanel sey, “Tisha, true-true, yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”


Den, dem kon bigin dey shaut, “Kill-am trowey! Kill-am trowey! Make yu kill-am!” Pilate kon ask dem, “Una wont make I nail una king for cross?” Di High Priest dem kon sey, “Di only king wey wi get na Caesar.”


E get 30 sons wey dey ride 30 donkey and dem get 30 towns for Gilead, wey dem still dey koll Jair village.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ