Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 9:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Tyre pipol build strong house for demsef kon gada many gold and silva like sey na san-san!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 9:3
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem go di sout-side for Tyre town wey dem fence kon rish all Hiv and Kanaan pipol town and dem stop for Beersheba for Judah sout.


Na gold dem take make di cup wey Solomon take dey drink wota and all di spoons and plates wey dey di hall for Lebanon forest. Dem nor use silva, bikos silva nor get value for Solomon time.


Wen Solomon dey rule, silva dey evriwhere like ordinary stone for Jerusalem and cedar tree dey kommon like ordinary trees for Jerusalem.


If yu stop to porshu money kon trowey yor gold for river,


Wiked pipol fit get plenty money like san, dia klot fit plenty pass evribody own,


I for dey rest with prince wey get gold and wey silva full dia palis.


God stresh en hand go di sea kon konker kingdoms, den kommand make dem distroy all di strong town for Kanaan.


Who bring all dis wahala kom Tyre wey en pipol na prince and wey pipol dey respet dia tradas well-well for di world?


Una enemies go kollect una money with evritin wey una get. Dem go break una wall kon skata all di house wey una build with betta money. Dem go take di fine stones, wood, rubi and evritin, den kon trow dem inside sea.


Una with una many goods, drivers, ship karpenter and sojas, go die inside di sea wen di ship don sink.


Wen en men enter sea go, dem dey give evry kountry wetin dem wont. Kings get money, bikos of di tins wey Tyre sell give dem.


Naw una don sink for sea. Una dey di sea bottom. Una goods and all una workers don vanish with una.’


God sey, “Tyre pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol and dem nor gri keep di agriment wey dem make with Israel.


E turn face Rama plus di strong-strong towns for Tyre, den e turn face Hosah kon end for di sea near Hebel, Akzib,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ