Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 9:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 God go appear on-top en pipol; E go shot en arrow like tonda lite. God wey get pawa go blow di trumpet; E go mash kom from sout under one heavy rain.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 9:14
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Heavy rain dey kom from sout, while strong kold breeze dey kom from nort.


E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash, dem kon dey konfuse more-more.


Den as God kommand and as E just breath, di sea bottom open and di eart foundashon kon dey show.


Make evribody wey dey for di world, listin! Una go si one flag on-top di mountin, den una go hear one trumpet sound,


Dis message na about Babilon. Just as strong breeze dey blow kom from desert, Na so wahala go kom from one land wey pipol dey fear.


Wen dat day rish, dem go blow one loud trumpet, den Israel pipol wey dem katch go Egypt and Assyria go kom back kon woship Oga God for en holy mountin for Jerusalem.


God go shaut well-well kon fight with pawa. Yes! E go vex kom with fire wey dey distroy, heavy rain and with big-big stone wey dey fall from heaven.


Just as bird dey fly round en house make e for protet en shidren, na so too God go protet and defend Jerusalem.”


God go kom with fire. E go ride kom with di kloud kon ponish doz wey E dey vex for.


As dem si yor arrow dey kom with speed and as yor spear dey shine, di sun and di moon nor fit move komot from where dem dey.


Wen en sojas gada dey kom like strong breeze to kom skata and opress us, Yu kill dem with yor arrow.


For dat time, God go protet doz wey dey stay Jerusalem and even doz wey weak pass among dem, go dey strong, just as David, dia grand-grand papa bi. David shidren-shidren go lead dem like God angel and dem go bi like God.


Den God go-go fight against doz nashons, just as E fight before.


God don promise sey na en go bi di fire wey surround di town like wall kon protet en pipol and E go stay der with all en glory.”


God go send en angels go blow loud trumpet and dem go gada di pipol wey E choose from evriwhere for di world.”


dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”


Yes! I go tok how Christ take do many mirakles and wonders thru di Holy Spirit pawa. I don prish di Good News from Jerusalem go rish Illyricum.


God use signs, mirakles and wetin di Holy Spirit do, take show sey, dia words na true.


Joshua katch all dis kings and dia land for just one fight, bikos di Oga wey bi Israel God dey fight for en pipol.


So I look kon si one white horse dey kom! Di pesin wey dey ride am whole bow and e wear crown for en head. E go fight and win many war and na champion e bi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ