But if una turn back from una sin kom meet mi and do wetin I kommand una, I go bring una kom di place wey I don choose sey una go for woship mi, even doh una skata for evriwhere for dis world.’
Den I ansa, ‘I go bring dem back from nort kon gada dem from evry part for di eart. Doz wey blind; wey nor fit waka; wimen wey get belle and doz wey won born, go follow dem kom back too. Dem go kom back as one great nashon.
“I go make Judah pipol strong and I go save Israel pipol. I go sorry for dem kon bring dem back to dia land. Dem go bi like pipol wey I neva rijet before. Na mi bi Oga dia God and I go ansa all dia prayers.
God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons.