Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 8:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 God wey dey lead heaven sojas sey, “My pipol wey remain fit tink sey all dis tins nor dey possibol, but with mi wey bi Oga God wey get pawa well-well, evritin dey possibol.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 8:6
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E get anytin wey too hard for God to do? As I tok before, nine monts from naw I go kom back and Sarah go born boy.”


One of di king ofisas ansa, “Abeg. Dat nor fit happen! Even if God ensef dey drop food from heaven, e nor go fit happen!” Elisha ansa, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from am!”


Dis na God handwork and e dey wonderful for awa eye.


‘My Oga God! Na Yu kreate heaven and eart with yor mighty pawa and great strent. Nor-tin dey hard for Yu to do!


‘Na mi bi di Oga wey bi evribody God. Nor-tin too hard for mi to do.


Jesus look dem kon ansa, “E nor possibol for human being, but evritin dey possibol with God.”


But since yu nor bilive wetin I tok so, yu nor go fit tok again, until di day wen dis tins go happen.”


Bikos e nor get anytin wey God nor fit do.”


Jesus ansa, “Wetin nor possibol for human being, dey possibol with God.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ