Make Yu ponish dat wiked animal wey dey wota and di nashons wey dey follow am, until dem go honbol demsef kon offa gold and silva give Yu. Make Yu skata doz pipol wey like war.
and pipol go dey sey, “Make wi klimb go God mountin. Yes! Make wi go Israel God Temple, den E go tish us wetin E wont make wi do and wi go waka for di road wey E choose. Bikos betta tishing dey kom from Jerusalem and God dey tok to en pipol from Zion.
Awa Oga God tell en pipol sey, “Si, I go lift my hand to di nashon kon tell di pipol my laws; dem go karry una shidren kom with dia hand kon put una dotas for dia shoulder.
God tell mi, “My savant, I get big work for yu; yu nor go only make Israel pipol wey survive, great again, but I go still make yu di lite for di nashons, so dat all di world go dey save.”
Naw, una go gada oda nashons wey una nor know before. And nashons wey nor know una before, go run kom meet una! Bikos mi wey bi di Oga una God, di Pesin wey bi Israel God wey dey holy, go make all dis tins happen. I go give una honor and glory.”
den, na only my name una go take swear sey, ‘As long as God dey alive, wi go do wetin wi promise’, den all di nashons go praiz mi and I go bless dem bikos of una.”
Pipol from many nashons go kom and dem go sey, “Make una kom make wi go di Oga mountin wey bi Jakob God house, so dat E go tish us en laws and wi go do evritin just as E wont am.” Nor bi only di pipol for Zion and Jerusalem go hear God word, but oda nashons go hear am too.
God go judge many pipol kon setol di kworel wey strong nashons get. Den dem go dey use dia swod and spears take dey work for farm. Pipol from difren kountry nor go fight each oda again or train dia pipol to go fight war.
Den all di pipol wey survive for di nashons wey attack Jerusalem go dey go der evry year go woship Oga God wey dey mighty and wey bi king and dem go still join celebrate Shelta Feast.
Pipol from one kountry go tell doz from anoda kountry sey, ‘Wi dey go woship Oga God wey get pawa kon pray make E bless us. So make una kom follow us go!’
Dem rite for God word before sey, “E go asept Gentile pipol, wen dem get faith” and na dis make am tell Abraham before di time rish sey, “E go bless evribody, bikos of am.”