Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 8:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Nobody go wahala dem wen dem dey plant dia seed. Dia vine go get many fruits; di groun go produce food and rain go always dey fall for dem. I go give all dis blessings to my pipol wey remain.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 8:12
39 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Isaak harvest plenty well-well and e rish hundred times of wetin e plant dat same year, bikos God don bless am.


Make God give yu di dew from di sky and di good tins wey dey di eart, plus many korn and wine.


E get one profet, en name na Elijah and e kom from Tishbe for Gilead. E go tell King Ahab, “As long as di Oga wey bi Israel God (wey I dey serve) dey alive, dew or rain nor go fall for some years, unless I kommand sey, make rain fall.”


Di mountin go karry peace news kom meet yor pipol and di hills go tok about korrect judgement.


Yes, God dey pour en blessings kom down, so awa land go produce betta-betta food again.


Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut, but if e favor yu, e bi like rain wey dey fall.


God go pour wota put for di seed wey una plant and di groun go produce plenty food for una. For dat time, una animals go chop betta green grass for field.


Una shame and disgrace don end. Una go stay for una own land and una propaty go bi times two, den una joy go last forever.


Bikos of di gift wey God give dem wey bi; korn, wine, olive oil, sheep and melu, dem go gada kom sing with happiness for Mount Zion. Dem go bi like gardin wey dem pour wota put well-well kon get evritin wey dem wont.


Di kountries wey hate dem nor go disturb dem again and wiked animals nor go kill or chop dem again. Dem go stay for peace and nobody go make dem fear again.


I go bring my pipol, Israel kom back to dis land. Di land go bi dia own and dia shidren nor go ever hongry again.


I go make di fruit and food for una tree and fields many pass before, so dat honga nor go make una go beg oda nashons.


I dey una side; I go make sure sey una land dey good and una go fit plant put again.


So just as dew dey vanish for morning, na so dis pipol go disappear too. Dem go-go like leaf wey breeze blow or smoke wey dey fade.


I go bi like dew to Israel pipol. Dem go shine like lily flower kon strong for groun like Lebanon tree.


God go ansa: “Naw, I go give una korn, wine, olive oil and una go chop beleful. Oda nashons nor go laf una again.


Make una animals nor fear. Di field go get grass; di trees go bear dia fruit and fig and grapes go plenty well-well again.


Israel pipol wey remain, nor go dey sin again. Dem nor go lie and to deceive pipol, nor go dey dia mind again. True-true, dem go dey chop and sleep well and nor-tin go make dem fear again.


Na dis tin make rain nor fall for di eart, so anytin wey una plant, nor dey grow.


But from today wey bi di twenty fourt day for di ninet mont, make una tink about how e bi before and naw wen una don build di temple again. Make una always dey tink of am.


Una korn, grapevines, fig trees, pomegranates and olive tree nor dey produce food since, but from naw go, I go bless una.”


God wey dey lead heaven sojas sey, “My pipol wey remain fit tink sey all dis tins nor dey possibol, but with mi wey bi Oga God wey get pawa well-well, evritin dey possibol.”


I nor go let ant distroy wetin una plant and grapes go full una gardin.


But make una first do di good tins wey God wont and evry oda tin go bi una own.


so, make wi stop to dey boast about wetin pesin do. Bikos both


Make wetin I dey tish una, fall on-top una like rain; make wetin I dey tok bi like dew for morning. Make my words fall like rain on-top grass and make e bi like shawa on-top plant wey just dey grow.


Moses pray for Josef tribe sey: “Make God bless una land with rain and with wota wey dey kom from under di groun.


So Israel pipol go stay for peace, Jakob pipol go prosper for di land wey get food and wine and dew go drop from heaven.


Pipol wey nor like trobol, dey plant fruit wey dey bring raitiousness.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ