11 But naw, God wey dey lead heaven sojas sey, “As for my pipol wey remain, I go dey trit dem well.
E nor dey always akuiz pipol or vex tey for dem.
Efraim pipol nor go jealous Judah pipol and Judah pipol nor go hate Efraim pipol again.
For dat time yu go sey: “Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi, but naw, Yu dey konfort mi and Yu nor dey vex again.
So God sey, “Make una tink about wetin bin dey happen to una before una start to ribuild di temple. But from naw go, evritin wey una dey do, go dey okay.
Una korn, grapevines, fig trees, pomegranates and olive tree nor dey produce food since, but from naw go, I go bless una.”