So dem chop and drink as dem dey happy for God present. Den dem kon dey shaut, “Na Solomon bi king.” Den, dem anoint am with God name as dia ruler kon make Zadok dia priest.
Una nor offa sheep for mi as ofrin; una nor gri honor mi with una sakrifice. I neva force una to serve mi with una ofrins or force una to give mi incense.
Di pipol ask, “Wetin make us dey fast and honbol awasef if God nor go ansa us?” God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast, una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.
Dem dey offa sakrifice give mi kon chop di sakrifice meat. But mi wey bi God nor dey happy with dem and naw, I go remember dia sin kon ponish dem. I go send dem go back to Egypt!
Dem nor go fit offa wine ofrin or sakrifice give God for der. Oga God nor go asept any of una sakrifice bikos e go bi like food wey dem offa give dead body and doz wey chop am, nor go dey klean. Una go only dey chop am bikos of honga, but make una nor bring any one kom God temple.
Dis nor bi di same message wey God tell una thru en profets before-before wen Jerusalem and Judah town dey stay for peace and wen Negev and Judah pipol still plenty?’ ”
Wen una rish der, una fit use di money take buy any food wey una wont, plus kattle, sheep, goats, wine or beer and anytin wey una like. Den make una do party for di Oga una God present kon celebrate with una family.
But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”