All di offisa for Judah sojas and dia men hear sey Babilon king don make Gedalaya govnor for Judah. So dem kon go meet Gedalaya for Mizpa. Di ofisas wey kom na, Netanaya pikin, Ishmael; Kareah pikin, Johanan; Tanhumet pikin, Seraya and Maakat pikin, Jaazanaya.
But for di sevent mont, Ishmael wey bi Netanaya pikin and Elishama grand-pikin wey dey join di royal family, kom with ten of en men kon kill Gedalaya, plus all di Judah and Babilon pipol wey dey with am for Mizpa.
Una nor offa sheep for mi as ofrin; una nor gri honor mi with una sakrifice. I neva force una to serve mi with una ofrins or force una to give mi incense.
Di pipol ask, “Wetin make us dey fast and honbol awasef if God nor go ansa us?” God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast, una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.
For di tent day for di fift mont for di nineteent year wey King Nebukadnezzar don dey rule, Nebuzaradan wey bi di king advise and dey kommand di sojas, enter Jerusalem.
For dat same year wen e dey rule, mi Daniel kom undastand di holy book wey sey na seventy years God tell Profet Jeremaya sey, Jerusalem pipol go skata for di world.
Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.
Den di angel pray to God, “Oga God wey dey mighty, Yu don dey vex for Jerusalem and Judah town for seventy years naw. How long e go take before Yu go sorry for dem?”
“Di fasting wey Judah pipol dey do for di fourt, fift, sevent and tent mont, go kon bi festival for joy and for betta tins. Una must love trut and peace.”
“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.
“Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
“Anytime wey una dey pray, make una nor do like pipol wey dey pritend, wey like to dey stand pray inside sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.