Dis message na about di animals for Negev: For der, di pipol pak dia propaty and money on-top donkey kon travel pass one land wey wahala and trobol full; where lions, snake and oda wiked animals dey stay. Dem travel go meet pipol wey nor go fit help dem.
‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.
Show dem where dem go pass run go Zion. Make dem run kwik-kwik, so dat dem go dey save! Bikos God dey bring wahala kom from nort and E go distroy well-well.
Na God wey dey mighty get today. Today, E go take revensh kon ponish all en enemies. En swod go kill all of dem. God wey dey mighty don sakrifice doz wey fall for en trap for di nort side for Eufrates River.
Benjamin pipol, make una run for una life! Make una run komot from Jerusalem! Make una blow trumpet for Tekoa kon put sign for Bet-Hakkerem, bikos wahala and distroshon dey kom from nort.
As I dey look, I si strong breeze dey blow kom from nort and tick kloud with tonda lite dey round am. Fire still dey der too and I si one tin dey shine inside di fire.
“Wen di end don rish, Egypt king go attack am. Siria king go fight am with all en pawa; with shariot and many ship. E go attack and distroy many kountries like river wey flow enter land.
Den wen di Lamb open di third one, I hear di third creature dey sey, “Make yu kom!” So I look and I si one black horse dey kom! Di pesin wey dey ride am hold ruler for en hand.