Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 6:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 I look up again and dis time, I si four shariot dey kom out from di centre for two bronze mountin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 6:1
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Elisha kon pray, “Oga God, make Yu open my savant eye, so dat e go si for ensef.” So God open di savant eye, so e kon si sey many horse with fire kover di mountins wey surround Elisha.


If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.


But God plan go stand forever; wetin E plan, nor go shange at-all.


Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom. Yu protet both pipol and animals.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


Even before I kreate di day, I bi who I bi and nobody fit eskape from my pawa. Na who fit shange or skata wetin I don do?”


God go kom with fire. E go ride kom with di kloud kon ponish doz wey E dey vex for.


Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”


But leave di body for groun kon kover am with iron and bronze. Leave am for der with di grass; make dew wet am and make e stay with di animals and grass.


Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


Di horn wey break wey four oda horns kon grow kom out for en place, na di four oda kingdoms wey go kom from en nashon, but dem nor go get pawa like am.


I look up again and I kon si one book dey fly for di sky.


E ansa, “Dis na di four spirit for heaven wey dey stand for God wey kreate di world front.” Dem dey go do en work.


and dem dey do wetin yu don already plan sey go happen.


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


Dis happen akordin to en plan wey go stand forever and E make am happen thru awa Oga God Jesus Christ


E dey karry weak pipol komot from san-san and dey make poor pipol sidan with prince and princess kon put dem for where pipol go honor dem. Di foundashon wey di eart sidan put, na God get am; na on-top am E build di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ