9 I look up again kon si two wimen dey fly kom meet us and dem get strong feada like bird own. Dem pick di basket kon fly go with am.
Di birds dey make dia house for der and di stork bird dey stay for di trees wey always dey green.
Just as bird for sky know wen to fly, na so too, dove, swallow and crane know wen to shange pozishon. But my pipol nor gri do wetin mi, wey bi God sey make dem do.
“Blow di trumpet! Enemies dey rush dey kom attack my pipol like eagle! My pipol don break di kovenant wey I make with dem kon go against my laws.
“ ‘Dis na di bird wey una nor suppose chop. Make una nor ever chop any kind vulture,
stork, any kind heron, hoopoe and bat.
So I ask di angel, “Di basket and di woman wey dey inside, na where dem dey karry dem go?”
Bikos na where dead body dey, na der vultures dey gada put.”
God go bring some pipol from far against una and dem go kill una like vulture. And dem bi pipol wey una nor go undastand wetin dem dey tok;