7 Den dem open di heavy kover wey dem take kover di basket and as I look am, na one woman sidan for inside!
Dis na di message wey God give Isaya wey bi Amos pikin about Babilon.
Dis message na about Moab. True-true na one day God go take distroy am; dem go distroy Ar and Kir wey dey Moab for one singol day.
Una make somewhere inside di town where una go dey store wota wey dey flow kom from di old pool. But una nor trust God wey make am. Una nor gri depend on God wey make all dis tins.
Den di man wey stand near di myrtle tree kon sey, “Na God send dem make dem go look how di eart bi.”
So I ask, “Wetin bi dat?” E ansa, “Na basket and na di whole land sin full inside.”
Den di angel sey, “Dis woman name na, ‘Wikedness.’ ” So e push di woman enter di basket back kon kover am.