6 So I ask, “Wetin bi dat?” E ansa, “Na basket and na di whole land sin full inside.”
Make una dey measure well for evritin wey una dey do. Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt.
Make una listin, una wey dey opress and distroy poor pipol wey dey di town.
Una dey tell unasef sey, “Wen di new moon festival go end sef, so dat wi go fit go sell awa korn? Na wen Sabat go end, make wi for fit sell again? Wi nor fit wait to shit awa customers, use wayo take measure tins, so dat wi go get more money.
Wi go buy poor pipol with money and doz wey nor get anytin, wi go buy dem with sandals kon even sell awa korn kanda too.”
Wetin I wont tok about wiked pipol house wey full with propaty wey dem kollect thru wayo? Dem dey shit pipol for market and I hate dat kind tin.
For dat day, I go ponish di pipol wey dey serve juju and wey turn dia oga house to where dem dey kworel and play pipol wayo.”
Den dem open di heavy kover wey dem take kover di basket and as I look am, na one woman sidan for inside!