5 Leta, di angel kon tell mi again, “Make yu look! Anoda tin dey kom!”
God kon tell mi, “Man pikin, look go di nort side.” I look and for der near di altar, I si di juju wey dey make God vex.
So di angel kon tell mi, “Make yu go tell evribody wetin God tok, ‘I love and dey koncern about Jerusalem and Zion wey bi my holy town,
I ask di angel wey dey tok to mi, “Wetin dis horn dem mean?” E ansa, “Dem stand for di wiked pawas for di world wey skata Judah, Israel and Jerusalem pipol.”
Den I ask, “Oga God, wetin all dis horse mean?” E ansa, “I go show yu wetin dem mean.”
Den di angel wey dey tok to mi kon waka go front and anoda angel kom meet am.
E ansa, “So yu nor know wetin all dis tins mean?” I ansa, “No o-o, my oga! I nor know.”