“Evritin wey I don tell yu about Israel, Judah and all di nashon, make yu go rite dem put for one book. Yu go rite evritin wey I tell yu from di first time wey I tok to yu, afta Josaya just bi king kon rish naw.
E kon ask mi, “Amos, wetin yu dey si?” I ansa, “Na ruler.” Den E sey, “I go test my pipol with dis ruler. I nor go shange my mind again and I go ponish dem.
E ask mi, “Wetin yu si naw?” I ansa, “Na one lampstand wey dem make with gold, wey get bowl where dem dey pour oil put. Seven lamps dey on-top di lampstand and each one get seven whole for di wick.