Den one of di angels kon sey, “Make una run! Make nobody look back and make una nor stop for di valley until una rish di mountin, so dat nobody go die.”
So naw, make una komot from Babilon, make una run komot from der! Make una shaut with joy as una dey tok about am. Make una tell evribody for di world sey, ‘God don save Jakob en savant.’
All of una wey dey karry di temple tins, make una know sey God go save una from Babilon. So make una nor tosh anytin wey dem dey forbid; make una make unasef holy, so dat una nor go die.
Jerusalem pipol, make una shake unasef kon dey free! Make una stand up from dirty kon sidan for una throne! Zion pipol, make una luz di shain wey tie una!
So Judah pipol, make una kwik-kwik komot from Babilon! Make una bi di pipol wey go first komot from der. Make una bi like man goat wey dey lead di oda goats.
So, make una run komot Babilon town! Make una run for una dear life! Make una nor die for nor-tin, bikos of Babilon pipol sin. I dey take my revensh and I go ponish dem well-well.
Jerusalem pipol, make una shaut and kry like woman wey won born, bikos dem must karry una go Babilon as slave. But God go save una for der; E go save una from una enemies hand.
E kon tell di kommunity sey, “Make una komot from doz wiked pipol tent and nor tosh anytin wey bi dia own, if not, God go distroy una bikos of dia sin.”