I ask di angel wey dey tok to mi, “Wetin dis horn dem mean?” E ansa, “Dem stand for di wiked pawas for di world wey skata Judah, Israel and Jerusalem pipol.”
Di first angel kon tell di sekond one, “Make yu run go tell di man wey whole di ruler sey, ‘Very soon, pipol and animals go plenty for Jerusalem, sotey di town nor go fit kontain dem again.’