Haman kon tell en wife Zeresh and all en friends evritin wey happen to am. En friends with en wife Zeresh kon tell am, “Yu don dey luz pawa to dis Mordekai. E bi Jew pesin and yu nor go fit win am. True-true e go win yu.”
But naw, doz wey distroy una, dem go distroy dem too and dem go karry all una enemies go Babilon as prisonas. Dem go opress doz wey dey opress una and doz wey tif from una, dem go tif from dem too.
So Oga God tell Satan, “Satan! Mi wey bi God rijet all wetin yu tok. Yes! God wey love Jerusalem go kondemn yu. Dis man nor bi like stik wey dem take komot from fire?”