Zekaraya 14:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
8 For dat day, na only fresh wota go dey rush kom out from Jerusalem. Half go-go di Dead Sea and di oda half go-go Mediterranean Sea. E go dey rush both for dry and rainin sizin.
Food and wota nor go hongry dem again. Sun and desert heat nor go burn dem again, bikos na di pesin wey love dem, go lead dem. E go lead dem go where wota for dey flow.
Den I go always guide and satisfy una with good tins. I go make una dey strong and well. Una go bi like gardin wey get plenty wota and like wota wey nor go ever dry.
I go remove di strong sojas wey kom from nort kon drive dem enter desert. I go drive dia leaders enter Dead Sea and doz sojas wey dey lead dem, I go drive dem enter Mediterranean Sea. Dia dead body go smell well-well. I go distroy dem, bikos of all wetin dem do una.
For dat time, sweet wine go dey pour like rain from di mountins and di hill go flow with milk. Wota go dey evriwhere Judah, but river go from God temple rush go wet Shittim Valley.
Pipol from many nashons go kom and dem go sey, “Make una kom make wi go di Oga mountin wey bi Jakob God house, so dat E go tish us en laws and wi go do evritin just as E wont am.” Nor bi only di pipol for Zion and Jerusalem go hear God word, but oda nashons go hear am too.
For dat time, E go stand on-top Mount Olives kon face di east side for Jerusalem. Den Mount Olives go divide into two from east go west. Half part for di mountin go-go nort and di remainin part go-go sout.
Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”
But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”
Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.