Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 14:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 For dat time, E go stand on-top Mount Olives kon face di east side for Jerusalem. Den Mount Olives go divide into two from east go west. Half part for di mountin go-go nort and di remainin part go-go sout.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 14:4
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David kon go Mount Olives bigin kry. E nor wear any shoe and e kover en head to show how e nor dey happy. All di pipol wey follow am still kover dia head as dem dey kry.


God glory kon komot di town go di east side for di mountin.


All di fish, bird, animal; weda dem big or small and evry human being wey dey stay dis eart, go fear mi well-well. Mountins go fall; high hill go skata and evry wall go fall skata too.


and I kon si Israel God glory dey kom from di east. God vois sound like nois from sea and en glory shine kover di eart.


Wen E stop, di eart go start to shake and wen E look, di nashons go bigin fear. All di mountins go skata; di hills wey dey since go sink and E go dey forever and ever.


All di land from Gibeah aria go rish Rimmon wey dey di sout, go klean like Arabah. But Jerusalem go high pass oda land wey dey round am; di town go start from Benjamin Gate go rish di Korna Gate kon from Hananel Towa go di Royal Wine press.


But e go happen for one special day and na only Oga God know di day. Normal day and nite go dey and even wen evening rish, lite go still dey shine like day time.


For dat day, na only fresh wota go dey rush kom out from Jerusalem. Half go-go di Dead Sea and di oda half go-go Mediterranean Sea. E go dey rush both for dry and rainin sizin.


“Even di strongest mountin nor go fit stand fight Zerubabel, bikos di mountin go turn ordinary groun for en front! And wen Zerubabel don put di final stone for where e suppose dey for di temple, di pipol go shaut, ‘Make God bless am! Make God bless di temple well-well!’ ”


I tell una true word, if anybody tell dis mountin, ‘Komot from here go enter di sea’ and di pesin nor get doubol mind, but bilive sey wetin e tok go happen, God go do am for am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ