Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 13:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 and if dem divide all di pipol wey dey di land into three, two part go die finish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 13:8
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even if na one pesin for evry ten pipol remain for di land, dem go distroy am, e go bi like oak tree or Asherah pole wey dem kut for groun or sometin wey dey holy wey dem distroy. Dis holy tin, na di special family wey God choose.”


All doz wey bin fight mi, dem go si dia dead body for road. Di worms wey chop dem nor go ever die and dem nor go ever kwensh di fire wey go burn dem. Dia dead body nor go dey good for human being to si.”


I go save and dey with una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una finish. I go ponish una, but I go do am small-small. Yes! I nor go let una go without ponishment. Mi, wey bi God, don tok.”


Doz wey bi sinnas, I go take dem komot from where una dey. I go take dem komot from di land where dem dey stay naw and dem nor go ever kom back to Israel land again. Den una go know sey na mi bi God wey get pawa.”


Some of una go die bikos of honga; sickness go kill some; swod go kill anoda set for outside di town and di remain wons, I go skata dem for air kon porshu dem with my swod.


“ ‘Dat ruler go enter agriment with many pipol for one week, den for di middle of dat week, e go stop all di sakrifice and ofrin. Den e go start one bad tin wey go kause wahala and tins go bi like dat, until di time wey God sey E won distroy di wayo pesin wey kause di wahala.’ ”


Doz wey dey sin among my pipol, dem go kill dem for war; pipol wey bin sey, ‘God nor go allow anytin bad happen to us.’ ”


Pipol wey dey honbol and good, na dem go stay with una and dem go dey save for God present.


Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.


Di king vex well-well kon send en sojas make dem go kill di pipol wey kill en savants and make dem burn evritin for dia town.


If God nor kut doz days short, nobody go save. But bikos of di pipol wey God don choose, E don make doz days short.


Den di big town divide into three and di nashons kon fall rish groun. So God remember Babilon wey big well-well and E gi-am di cup wey full with en vexnashon wine.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ