Zekaraya 12:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
6 For dat day, I go make Judah leaders bi like fire wey dey burn forest and farm wey ripe korn full. Dem go distroy all di nashons wey surround dem, den Jerusalem pipol go dey save.
Dem attack dia neighbour from rite, but dem still dey hongry. Dem chop dia neighbour from left, but dem nor beleful. Dem even dey chop dia own shidren join.
Jakob shidren-shidren go bi fire; Josef shidren-shidren go bi big smoke and Esau pipol go bi like leaf wey fall for groun, dem go burn dem rish groun, bikos God don tok!
God sey, “Jerusalem! Make yu raiz-up kon skata di nashons, bikos I go give yu iron and bronze horn, so dat yu go fit distroy many nashons! Yu go give di propaty and di money wey dem tif to Oga God wey dey rule di eart.”
Di first angel kon tell di sekond one, “Make yu run go tell di man wey whole di ruler sey, ‘Very soon, pipol and animals go plenty for Jerusalem, sotey di town nor go fit kontain dem again.’
Oga God wey get pawa go protet en pipol and dem go distroy dia enemies. Dem go dey shaut for war like who drink dey katch and dem go kill dia enemies finish. Dia enemies blood go plenty well-well like sakrifice blood wey dem pour put for di altar.