God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”
Pipol wey I koll my own don turn against mi like lion for forest; di way dem dey tok to mi, bi like wen lion dey shaut. So I go trit dem like sey I hate dem.
Make Yu remember yor promise and nor hate us. Nor disgrace Jerusalem, di place wey yor throne wey get glory, dey. Abeg, make Yu nor break di kovenant wey Yu make with us.
Yu really bi yor mama pikin. Yor mama run leave en husband and shidren. Yu bi like yor sista wey hate en husband and shidren too. Yu and Hit wey bi di oda town get di same mama and na Amor bi una papa.
My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.
So God sey, “All di bad tins wey dem dey do, na Gilgal dem from start am and na from der I start to hate dem kom. I go drive dem komot from my land, bikos of di evil wey dem do. I nor go love dem again. Yes! Even dia leaders don go against mi.
I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.
“But even wen dem still dey dia enemy land, I nor go leave and distroy dem finish. Bikos dat one go make my kovenant with dem end, na mi bi di Oga dia God.