Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 11:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 “Doz wiked shepad go die finish! Dem don leave dia sheep. Dem nor go get pawa again; dem nor go fit karry dia hand take fight and dia eyes go blind.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 11:17
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen King Jeroboam hear dis tin, e point kon sey, “Make una hold dat man!” At wons, di king hand paralaiz and e nor fit strait am again.


God don make una dey do like sey una don drink, so una go sleep go. God don blind di profets eyes and doz wey dey sey future nor go fit si anytin again.


Na only fool go make en own god – yeye god wey nor go fit help or fight for am.


Na di old pipol and rulers, bi di head, while di tail, na di profet wey dey lie waka.


God tell mi, “Make yu go Judah king palis kon tell am dis message:


“E go bad well-well for doz leaders wey suppose kare for my pipol just as shepad dey kare for en sheep, but dem nor do am, instead dem distroy and skata my pipol.


Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all. Mi, wey bi God don tok.”


God wey get pawa sey: E nor go betta for foolish profets wey dey follow dia own spirit, even wen dem neva si anytin at-all!


“Man pikin, go tok against di leaders for Israel. Tell dem sey mi wey bi God sey: ‘Una wey dey kare for Israel pipol, una own don finish! Una guide unasef kon leave Israel pipol on dia own.


Pipol dey go meet juju priest and doz wey dey si tumoro, but dem just dey lie and deceive dem. Some dey tok wetin dreams mean, but dem dey only deceive una and na only yuzles hope dem dey give. So many pipol dey waka anyhow like sheep wey waka lost. Dem dey trobol, bikos dem nor get who dey lead dem.


Den God tell mi, “Make yu bihave like sey yu bi shepad again. Dis time, yu go bihave like yuzles profet.


“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.


“E go bad for una, leaders wey blind, una sey, ‘Anybody wey take di temple swear, nor-tin go do am. But if e take di gold for Temple swear, curse go dey for en head.’


“God don blind dia eye and make dia heart strong like stone, so dat dem nor go si with dia eye and undastand with dia heart, so dem nor go fit kom meet mi, make I for heal dem.”


Jesus tell am, “I kon judge pipol for di world, so dat di pipol wey nor dey si, go bigin si and doz wey tink sey dem dey si, dia eye go blind.”


Dis mean sey, na only few pipol for Israel fit get wetin all of dem dey find. Di rest nor gri listin to God, bikos of dia sturbones,


So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey.


Make yu listin, di time dey kom wen I go kill all di yong men wey dey yor family and town, so dat no man for yor family go get long life.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ