Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 11:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Even doh I put shepad make e kare for my sheep, e nor go fit do anytin wen odas dey treaten to distroy di sheep. E nor kare about di ones wey lost or wound or to even feed di odas. Instead, e dey kill di betta ones chop kon trowey di rest part for bush.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 11:16
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“I don dey with yu for twenty years naw. Yor animals wey get belle dey always born and I neva for one day chop one among yor animals.


Jakob kon tell Esau, “My oga, yu know sey di shidren still small and I dey kare for di animals wey just born, if wi sey make wi travel with dem for just one day, all di animals fit die.


E go kare for en animals just as shepad dey do. E go gada di lamb togeda kon karry dem for en hand; E go lead and guide dem.


Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok about di rulers wey suppose kare for en pipol: Bikos una nor kare for my pipol and una skata and drive dem komot, I go ponish una for di wiked tins wey una do.


How I wish dem know wetin I dey tink for my mind, den dem for fit prish my message give my pipol, so dat dem go stop di kind life wey dem dey live and di bad-bad tins wey dem dey do.


Mi wey bi God wey get pawa dey sey I bi una enemy. I go take my sheep from una hand and una nor go bi dia shepad again; I nor go let una kare for unasef again. I go save my sheep from una and una nor go chop dem again.


“Doz wey don lost and wey waka anyhow, I go find and bring dem kom back. Doz wey get sore, I go bandage am for dem kon heal doz wey dey sick; but doz wey fat and strong, I go distroy dem, bikos I bi shepad wey dey do wetin dey rite.


Yes! Una push di ones wey dey sick kon drive dem komot from where di oda sheep der.


“Den di king go do wetin e like. E go dey make mout and karry body up sey, ‘I get pawa pass any oda god. I even high pass God wey dey heaven.’ E go dey susid until di time wey God won ponish am, don rish. God go do wetin E don plan.


“Na true word I dey tell una, pesin wey nor pass door enter di place where dem dey keep sheep, but klimb pass anoda side enter di place, na big tif.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ