All dis nor dey join di oda tins wey e dey get from doz wey dey buy and sell. All Arabia kings and govnor from di aria, dey still bring gold and silva kon gi-am.
How una go take ansa di messenjas wey dey kom meet una from Filistia land? True-true, God don make Zion great and en pipol wey dey sofa, go dey save for der.
But pipol wey dey wait for God to kom help dem go get new strent and pawa. Dem go fly high like eagle; even wen dem run, dem nor go taya and wen dem waka, dem nor go faint.
One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.
For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.
So, Jesus ansa dem, make una go tell John wetin una don si and hear: “Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka before, dey waka, pipol wey get leprosy, dia body don klean, pipol wey nor dey hear, don dey hear naw, pipol wey don die, don wake-up and even poor pipol, don hear di Good News.
Den wen wahala and sofa fall for dia head, dis song go bi witness against dem, bikos dia shidren-shidren nor go forget am. I know wetin dem dey tink for dia mind today, even before I take dem go di land wey I promise dem.”
Bikos I know sey wen I don die, una go spoil unasef kon turn from dis way wey I kommand una. Wahala go kom meet una dat time, bikos una don do bad tins wey go make God vex.”