Make Yu remember yor promise and nor hate us. Nor disgrace Jerusalem, di place wey yor throne wey get glory, dey. Abeg, make Yu nor break di kovenant wey Yu make with us.
I tell Israel pipol dis message: ‘Una dey happy, bikos of una temple. Una like to dey look and go der, but I go distroy am and di small-small pipol wey una get for Jerusalem go die for war.’
“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.
Na pipol wey dey buy and sell di sheep, hire mi and I kon turn shepad wey dem won go kill en sheep. I take two stik kon koll one, “Favor” and di oda one na, “Unity.” So I kon dey kare for di sheep dem.
Akordin to di days wey una take shek di land, na so too una go sofa for una sin for forty years; one day go bi for one year, den una go know how e bi to make mi vex!’
“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!