Zekaraya 10:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
11 Dem go cross rof river and I go stop di wave and Nile River go dry finish. Assyria wey bin dey karry body up, go honbol demsef and Egypt wey dey strong, nor go get pawa again.
Den e take di garment wey Elijah drop for am take nak di wota kon sey, “Where di Oga wey bi Elijah God?” Den e nak di wota again and di wota divide into two. So Elisha kon waka pass go di oda side.
Dem happy well-well as dem dey celebrate di Bread wey nor get Yist Feast, for seven days. Belle sweet dem well-well, bikos God shange Assyria king karata and e kon support dem as dem dey ribuild Israel God Temple.
I go distroy Assyria pipol for my land. I go skata dem put under my hill. I go free my pipol and remove di load wey Assyria pipol put for dia shoulder.
Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.
Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.
I go skata di land for nort with my hand kon distroy Assyria land too. I go turn Nineveh, di main town to where dem dey trowey dirty put and e go bi desert.