Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 10:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 I go bring dem kom back from Egypt and Assyria kon make dem stay dia own kountry again. I go still make dem stay for Gilead and Lebanon and dia pipol go full di whole land.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 10:10
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even una small family wey dey honbol demsef, go dey great like nashon wey get pawa well-well. Wen di time rish, I go make dis tins happen kwik-kwik. Na mi wey bi God, tok am!”


“Even doh Judah royal palis fine like Gilead land and Mount Lebanon, I go turn am to desert and pipol nor go stay der again.


I go take Israel pipol go back to dia land. Dem go chop from Mount Karmel and Bashan. Dem go chop beleful for Efraim hill and Gilead land.


I go shaut like lion kon fight my pipol enemies, den my pipol go follow mi. Dem go rush kom meet mi from west.


Dem go rush kom from Egypt like bird and from Assyria like dove. I go bring dem kom back to dia town again. Mi, wey bi God, don tok.”


Doz wey dem katch for Israel before, go kom back kon stay for Foenicia wotaside wey dey nort for Zarefat. Jerusalem pipol wey dem katch and karry go nort go kom back to dia house for Negev.


Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.


God wey dey lead heaven sojas sey, “My pipol, make una dey sure sey I go save una from di land wey dey east and west.


I go bring una kom back to una house and una go get peace for Jerusalem. Una go bi my pipol and I go bi una God wey go rule and judge una well.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ