But na God do wetin E plan. E don do wetin E promise and E warn us about am since. E nor sorry for Jerusalem kon distroy am. E give awa enemies viktory and dem dey happy, bikos God don distroy us.
Den I hear di man wey wear linen wey dey on-top di river as e raiz en two hand face sky kon swear with God name sey: “Na only three and half years remain; by di time wen God don save en holy pipol from who dey sofa dem, all dis tins go don happen.”
I ask di angel wey dey tok to mi, “Wetin dis horn dem mean?” E ansa, “Dem stand for di wiked pawas for di world wey skata Judah, Israel and Jerusalem pipol.”