so Yu kon allow dia enemies win and rule dem. But wen dem koll Yu for help wen dem dey trobol, Yu ansa dem from heaven. Bikos of yor great mesi, Yu send leaders wey kom save dem from dia enemies.
Blacksmit dey melt iron for fire. E go nak am with hammer until e get di shape wey e wont and na en strong hand e take dey make am. Wen e hongry, e go kon weak. If e nor si wota drink, e fit faint.
Israel pipol pass thru di desert and dem nor tosh Edom or Moab pipol with dia land. Dem travel go east for Moab land kon go kamp for di oda side for Arnon River, but dem nor cross Arnon, bikos Arnon divide Moab kountry.