“Yu show sey yu dey sorry for di bad tins wey una do kon respet God wen yu hear how I won use dis place and di pipol wey dey stay here, as strong ezample for pipol wey dem curse.” ’ God sey, ‘Yu tear yor klot kon kry for my present and I don hear yu.
Even afta di ponishment wey don happen to us bikos of awa sin, wi still know sey Yu, awa God, dey sorry for us, bikos even doh Yu dey ponish us, Yu still help us survive am.
But wen dem kom dis land kon dey stay as dia own, dem nor kon dey obey yor kommand or do wetin Yu tish dem; dem nor do wetin Yu orda dem to do and na dis make Yu distroy dem.
Na dis make mi pour my fire and vexnashon for Judah towns and all di street for Jerusalem. As e bi naw, dia life don skata and pipol wey si dem, dey fear.
So, dem go feel my strong vexnashon. I nor go sorry or pity for dem. Dem go shaut well-well as dem dey pray give mi, but I nor go ansa or listin to dem.”
E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’