Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 1:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Den di angel pray to God, “Oga God wey dey mighty, Yu don dey vex for Jerusalem and Judah town for seventy years naw. How long e go take before Yu go sorry for dem?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 1:12
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, wetin God tok thru Profet Jeremaya kon happen. “Dem go abandon di land; di land go rest well-well until di seventy years don komplete just as God tok am.”


bikos of di way Yu dey vex for mi. Yu don pick and trow mi go down.


Yu go raiz-up kon sorry for Jerusalem, bikos dis na di time wen Yu go favor am. Yes! Dis na di rite time to help am.


My God Yu know all di sins wey I kommit for sekret; bikos my sins nor fit hide from Yu.


So God, na how long e go take before Yu go stop awa enemies wey dey curse us? Yu go let dem take yor name make yeye forever?


My God, na how long Yu go dey vex with us? Na forever? Na how long yor vexnashon go dey burn like fire?


Time dey to kill and time dey to heal pesin; time dey to skata and time dey to build.


I bin dey vex for my pipol and na dat make mi allow yu attack dem; but yu nor sorry for dem at-all and yu even dey ponish di old pipol among dem.


from all dia sofa. Nor bi angel save dem, but na God save dem by ensef. E use en love and mesi take save dem. E dey kare for dem since,


Na how long awa land and di grass for di farm go dey dry? Awa animals and birds dey die, bikos of dis pipol wikedness! Pipol wey sey, ‘God nor dey si wetin wi dey do.’ ”


I nor dey spend my time to play and enjoy mysef with oda pipol. I dey always dey alone; dey obey yor word and I dey vex for evil pipol, bikos of wetin dem don do.


“God sey, ‘Wen di seventy years wey I give Babilon don finish, I go kare and bring una kom back to una land, just as I promise.


God sey, “I go bring my pipol kom back to dia land kon sorry for dem. Dem go build Jerusalem again and di king palis go dey as e bi before.


One kon tell di oda one wey wear linen, wey dey on-top di river, “Wen all dis wonderful tins go happen?”


For dat same year wen e dey rule, mi Daniel kom undastand di holy book wey sey na seventy years God tell Profet Jeremaya sey, Jerusalem pipol go skata for di world.


Oga God, e don tey wen I dey kry make Yu kom help mi, but Yu nor gri ansa! I kry sey, “Trobol dey evriwhere!” But Yu nor still gri kom save mi.


For inside vishon dat nite, I si one man dey ride one red horse, den e stop for one valley wey trees full and I kon si anoda red, brown and white horse wey get black spot for body, dey follow am for back.


“Make yu ansa di pipol and di priests, ‘Since una dey fast for di fift and sevent mont for seventy years naw, una really dey do am bikos of mi?


So, di pipol wey Jesus take go meet God, e go save dem for forever and ever, bikos e dey alive to pray for dem.


Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ