Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zekaraya 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 So dem go back kon tell di angel, “Wi don go round di eart kon si sey peace dey evriwhere.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zekaraya 1:11
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God ask Satan, “Where yu from dey kom?” Satan ansa, “I just dey waka anyhow for di world.”


Wen Oga God appear to en pipol for Mount Sinai, E kom with angels and shariot wey nobody fit kount.


But naw, di whole eart dey rest; get peace and evribody dey sing with happiness.


Di angel sey, “Yu know wetin make mi kom meet yu? Naw, I won go fight Persia prince. Wen I don go, di angel wey dey guide Greece go kom.


Den di man wey stand near di myrtle tree kon sey, “Na God send dem make dem go look how di eart bi.”


but I dey vex for di nashons wey feel sey dem dey save. Bikos as I dey try make I nor vex for my pipol, doz nashons dey make my pipol sofa more-more.


For inside vishon dat nite, I si one man dey ride one red horse, den e stop for one valley wey trees full and I kon si anoda red, brown and white horse wey get black spot for body, dey follow am for back.


As di strong horse dem kom out, dem rush dey go patrol di eart. Di angel kon tell dem, “Make una go patrol di eart well-well!” So dem kon go.


God Pikin go send en angels make dem go remove evritin inside en Kingdom wey dey make pipol sin and break God law.


Na so e go bi for di day wen di world go end. Angels go kom separate evil pipol from di good ones


“Wen Man Pikin and en angels go kom with en glory, e go sidan for en king throne.


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


And una wey dey sofa so, God go give wi and una rest wen Christ go kom from heaven with en mighty angels.


Dis vishon na from Christ and na God sey make e show en savants wetin go soon happen. E make am klear thru di angel wey E send kom meet John


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ