I go gada my pipol wey remain from di kountry where I skata dem put kon bring dem kom back to dia land. Dem go get many shidren kon prosper for evritin and for evry side.
Jerusalem road dey mourn, bikos nobody dey pass der go celebrate again. Di town gate kwayet and pain won kill di priests dem. Di yong wimen dey kry, bikos di trobol wey dem dey face, too mush!
Even inside en pain, Jerusalem remember wen e nor get money or house to stay. E still remember all di propaty wey e bin get. But naw, en enemies don attack am and nobody gri kom help am. Di way e take fall, dey make en enemies laf.
I go remove dem from strenja land; gada dem togeda kon bring dem back to dia own kountry. I go lead dem go back to di mountin and Israel river wey dey flow kon give dem betta food chop.
“Make yu pass thru evriwhere for Jerusalem kon mark di pipol front head; pipol wey dey face trobol and wahala, bikos of all di bad tins wey dey happen for di town.”
Den Judah and Israel pipol go kom togeda as one again. Dem go choose one pesin wey go lead dem and dem go plenty kon prosper for dia land again. Yes! Dat day for Jezrel, go dey great well-well!
For dat time, I go gada and bring una kom back to una house. Wen I dey give una evritin wey una don lost before, I go make evribody for dis world respet and honor una.” Mi, Oga God, don tok.