“But naw, for dis short time, awa Oga God, Yu don trit us well kon stop some of us to bi slave and wi dey live for peace for dis Holy Place. Yu don remove us from slave work kon give us new life.
How una go take ansa di messenjas wey dey kom meet una from Filistia land? True-true, God don make Zion great and en pipol wey dey sofa, go dey save for der.
All of una wey dey respet God and obey en savant words, di road wey una dey waka fit dey dark, but make una trust una Oga God! Make una put hope for una God.
Even if na one pesin for evry ten pipol remain for di land, dem go distroy am, e go bi like oak tree or Asherah pole wey dem kut for groun or sometin wey dey holy wey dem distroy. Dis holy tin, na di special family wey God choose.”
Wen dat time rish, sin nor go dey for Israel land again and wikedness nor go dey Judah, bikos I go forgive doz wey I save dia life. Mi, wey bi God, don tok.”
Na pipol wey dey buy and sell di sheep, hire mi and I kon turn shepad wey dem won go kill en sheep. I take two stik kon koll one, “Favor” and di oda one na, “Unity.” So I kon dey kare for di sheep dem.
Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News.
My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?