Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Zefanaya 2:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 I go skata di land for nort with my hand kon distroy Assyria land too. I go turn Nineveh, di main town to where dem dey trowey dirty put and e go bi desert.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Zefanaya 2:13
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But God sey, “Wen I finish wetin I dey do for Mount Zion and Jerusalem, I go ponish Assyria king, bikos e dey proud and e too boast.”


Bikos of dis, Oga God wey get pawa go ponish en pipol with sickness. Yes! En glory go-go up like smoke.


God sey, “I dey use Assyria pipol as weapon to take ponish pipol wey I dey vex for.


Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.


Dis na wetin I plan for di whole eart; my hand dey ready to ponish di nashons.”


Den King Sennakerib for Assyria kon go back to Nineveh.


Hazor go turn desert forever and na only jackals go dey stay der. Nobody go ever stay der again.” ’ Mi, wey bi God, don tok.”


sey, “Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol about my judgement wey dey kom, bikos I don hear how di pipol for der wiked rish.”


“Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol my message.”


Dem go rule Assyria with dia swod kon enter Nimrod land. E go save us from Assyria pipol wen dem kom attack us.


Dis na di message wey God give Nahum wey kom from Elkosh town and na about Nineveh pipol.


But know matter wetin una do, fire go still kill una; una enemies go kill una like lokust. Dem go kill evritin wey dem si and una nor go fit eskape, even if una plenty like many lokust.


Evribody wey si una go-go back kon sey, ‘Nineveh own don finish! Where dia pipol wey dey kill odas? Who dey kry sey dem distroy una?’ ”


Na with my hand I go take skata Judah, Jerusalem and evritin wey koncern di Baal juju wey dem dey woship. I go distroy all dia wiked priests and nobody go remember dem again,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ