Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Titus 3:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 If anybody dey won kause kworel for di church and yu don warn am rish two times and e nor gri shange, den make yu drive am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Titus 3:10
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Naw, my brodas and sistas, I dey beg una, make una know di pipol wey dey kause wahala and oppoz di tishing wey una don learn from us. Den make una nor go near dem!


Bikos if una nor kworel, wi nor go know di good ones among una.


Wen I dey with una for my sekond visit, I tell una wey dey sin before about dis tins. Even doh I nor dey with una naw, I dey tok am again sey, if I kom again, I nor go sorry for anybody, but I go ponish am,


I wish sey doz wey dey disturb una go-go sekonsaiz demsef!


to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol;


But if anybody nor obey awa message thru dis leta, make una look dat kind pesin well-well and make nobody follow am waka or do anytin togeda, so dat shame go katch am.


My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem.


If yu look dem well-well, dem bi like God pipol, but dem don rijet God pawa. So make yu run from dis kind pipol.


As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.


If anybody kom meet una and e nor asept wetin wi dey tish, make una nor welkom or receive am as una broda.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ