Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Titus 2:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Make yu prish di trut, so dat pipol nor go get rizin to tok against yu. Den doz wey dey oppoz yu, go shame and dem nor go get word to tok about us.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Titus 2:8
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den I sey, “Wetin una dey do so nor good! Una nid to respet God and dey do wetin korrect. Den una nor go give awa enemies wey bi Gentile pipol, any shance to laf us.


Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.


Jesus tell dem, “Make una give Caesar di tins wey bi Caesar own and make una give God di tins wey bi God own.” Dem sopraiz well-well for wetin Jesus tok.


So, one man wey sabi di law kon dey hear dem dey argue. Wen e si sey Jesus dey ansa dem well, e kon ask am, “Wish kommandment big pass?”


Di man wey dey tish di law kon tell Jesus, “Na thru, Tisha. Yu dey korrect for wetin yu tok, na only God bi Oga God and know oda god dey apart from am.


Wen Jesus si sey di man tink well before e ansa, e kon tell di man, “Yu nor dey far from God Kingdom.” From dat time, nobody get di mind to ask am any kweshon again.


Wen Jesus tok dis tin, shame katch all en enemies, so di pipol kon dey happy, bikos of wetin Jesus dey do.


But if anybody nor obey awa message thru dis leta, make una look dat kind pesin well-well and make nobody follow am waka or do anytin togeda, so dat shame go katch am.


So I wont make di yong wimen marry; born shidren; dey guide dia house, so dat enemies nor go get shance to akuiz dem.


If anybody dey tish wetin nor korrect and nor gri with awa Oga God Jesus Christ tishing and as God wont make wi dey live awa life,


Like dis too, awa pipol go learn how to do good and help pipol wey really nid help. And as dem dey do like dis, dem nor go live yuzles life.


So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.


Bikos God wont sey, wetin una dey do, go make di pipol wey nor get sense shut up dia mout.


But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ