Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.
But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.
Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.