15 Make yu tish dem dis tins and korrect dem with boldness. So, make yu nor let anybody trit yu like small pikin.
bikos e tish dem like pesin wey get authority and nor bi as dia law tishas dey do.
Di pipol sopraiz, bikos e sabi tish pass di law tishas.
Evribody sopraiz dey ask each oda, “Wish one bi dis? Dis new tishing strong o-o! Even wiked spirit dey obey en kommand.”
Di pipol sopraiz kon dey ask each oda, “Wetin dey happen so? Dis man dey use God pawa take kommand demon and dem dey obey am!”
So make evribody respet am, den make una send am kom meet mi with peace, bikos I dey espect am with di oda brodas.
Doz wey dey sin, make yu korrect dem for evribody front, so dat e go bi warnin to odas.
Make yu dey prish God word and dey ready, weda di time dey okay or not. Make yu use patient take korrect and enkourage yor pipol with betta tishing.
Wetin di profet tok, na true. So bikos of dis, make yu stop dem, so dat di bilivers go strong for faith.
Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!