Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Titus 1:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Even one among dia own profets sey, “Krete pipol dey always tok lie, dem bi wiked animals and lazy pipol wey get long-trot.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Titus 1:12
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos na inside am wi dey live, waka, get life and some of una wey dey rite poem tok sey, ‘Wisef na God pikin.’


weda dem bi Jew or Gentile, wey dey serve God with dem, like pipol from Krete and Arabia, all of us dey hear, as dem dey use awa language praiz God!”


Bikos di place where ship dey pak put wen dem si, nor good for kold weda; some for di pipol kon gri sey make wi dey go. Dem dey hope sey wi go fit rish Foenix, wey dey Krete, wey face sout-west and nort-west, so dat wi go fit spend kold sizin for der.


Wen one kind kwayet breeze blow kom from sout, dem tink sey dem go fit do wetin dem plan, so dem kon dey go small-small pass Krete wotaside.


Wi dey go small-small for many days and nor bi small wahala before wi fit rish Cnidus. Bikos di breeze nor make us fit go front again, wi kon drive small-small dey go Krete, wey dey opposite Salmone.


Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.


Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.


Dis pipol dey lie and na wayo dem sabi do and dia mind don skata.


Titus! Na dis message make mi leave yu for Krete, so dat yu go kontinue awa work for der and pick new leaders for each town, just as I kommand yu.


But dis men bi like animal wey nor dey tink; animals wey pipol fit kill anyhow and dem just dey do as dem like. Dis pipol dey tok anyhow and na distroshon go end dia life.


Since dem komot from di rite way, dem don miss road, bikos dem dey follow Balaam, Beor pikin, wey love bad tins!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ