So, I go give dia wifes to oda men kon give dia farm to oda pipol. I go do am, bikos both rish and poor pipol dey use wayo take dey get dia money. Even profets and priests don join dey deceive pipol too.
Una disobey mi for my pipol front, so dat una go get small rice and bread to chop. Una kill pipol wey una nor suppose kill and pipol wey una suppose kill, una nor kill dem. So una dey lie give my pipol and dem dey bilive una.’ ”
Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”
Dis na wetin God tok: “Una wey bi lie-lie profets dey make my pipol sin! If pesin give una food chop, una go sey make peace dey with am, but doz wey nor give una, una go won fight dem.
“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.
Di pesin wey dem hire nor bi di shepad and bikos nor bi en get di sheep, e go run wen e si lion dey kom, so di lion go skata di sheep, kon kill di ones wey e katch.
But if di woman get shidren or grand-shidren, di first tin wey dem go do for dia family, na to show sey dem dey fear God, as dem dey kare for dia papa and mama. Dis na wetin dey make belle sweet God.
Bikos na dis pipol dey hide enter pipol house kon sleep with wimen wey nor get sense; wey dey sin well-well and wetin dey sweet dis wimen to do, na-im dey kontrol dem.
Make pesin wey bi leader nor get fault, bikos na God work e dey do. Make e nor dey karry body up; dey kwik vex or drink anyhow; dey like to beat pipol or love money.