9 Bikos na so God tok for en promise, “Wen di time don rish, I go kom back and Sarah go born boy.”
But I go keep my kovenant with yor pikin Isaak, wey Sarah go born for dis time next year.”
One of dem kon sey, “Nine mont from naw, I go kom back and yor wife Sarah go born boy pikin.” Sarah dey di house back door dey listin.
E get anytin wey too hard for God to do? As I tok before, nine monts from naw I go kom back and Sarah go born boy.”
So Sarah get belle and e born boy for Abraham for en old age for di real time wey God don tell am.
Naim make I sey for dis matter so, make una remove una hand and leave all dis men, bikos if all di tins wey dem dey plan and do, na from dia mind, dem nor go susid,
Na faith make Abraham offa Isaak wen God dey test am. Even doh na God gi-am di pikin, e still ready to give di only pikin wey e get, back to God.