Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 9:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 Bikos God go kwik do wetin E sey E wont do for dis world, E go kom judge di world.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 9:28
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu really ansa awa prayers wen Yu show us how Yu take dey save and diliver us. Di whole eart trust Yu; plus pipol wey dey di oda side for di sea.


E go judge di world well kon rule di pipol with betta mind.


But as Israel pipol plenty like san-san for wotaside, na only few go kom back, bikos na di distroshon wey fit dem, dey wait for dem.


Yes! Oga God wey get pawa go bring distroshon kom di whole kountry, bikos E don tok am.


So make una nor laf as I dey warn una, if not, e go hard una well-well to eskape. Bikos I hear wen God wey get pawa sey E go distroy di whole kountry.


Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol, dem go praiz am and afta E don judge all of dem, evribody go know sey Oga God get pawa well-well.


bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again.


bikos E don choose one day wey E go take judge di world with raitiousness thru di man wey E choose and show evribody wen E raiz am from deat.”


Den I si heaven open and one white horse dey kom out! Dem dey koll di Pesin wey dey ride di horse, “Faithfulnes and Trut.” E dey judge without parsha or wayo even as E dey go fight war.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ