God wey bi awa grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob God, make yor pipol always dey ready to obey Yu forever, so dat Yu go always make dem dey faithful to Yu.
E go first kom with Elijah spirit and pawa, before di Oga God ensef go kom. E go make papa setol with dia shidren and pipol wey nor dey obey God before, e go make dem obey am naw, so dat dem go dey ready to meet am for heaven.”
Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.
God wont make dem know di rishis wey dey en glory; wey di sekret get for evribody and na-im bi Christ wey dey inside una. So una get hope sey una go share for God glory.