11 Even before dem born di shidren or sey dem do any bad or good tin, God tell Rebekah, “Di senior pikin go serve en junior broda, so dat my promise go stand:
God word sey, “I don make yu papa for many nashons.” So for God eye, Abraham na awa papa, bikos e get faith for God wey get pawa to raiz pipol wey don die and to kommand tins wey nor dey before, like sey dem dey.
Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.
E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.
Dem go follow di Lamb fight war, but di Lamb go win dem, bikos na en bi Oga God for all ogas, King for all kings and pipol wey dey follow di Lamb, na doz wey e koll, choose and save.”